π 1. Na person wey never see problem dey use English dey pray.
π 2. Book wey no gree enter head go enta exam hall .
π 3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.
π 4. Who naked no dey chuck hand for pocket…!
π 5. Wetin concern dog wit family planning?..
π 6. Na determination dey make Okada overtake trailer for road.
π 7. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.
π 8. Pikin wey go strong go strong…. No be say until dem name am Samson.
π 9. Na over confidence make February no complete.
π 10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.
π 11. Head wey no wan think go carry load..
π 12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.
π 13. Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish.
π 16. No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile.
π 17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.
π 18. Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote .
π 19. Escort me, escort me naso slave trade take start.
π 20. It’s a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
π 21. Christianity is free, but you must buy Bible
π 22. Person nor dey use shame chop winch o
π 23. Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.
π 24. You no need spoon and cutlery to chop slap.
π 25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.
π 26. The patient dog Nah hungry go kill am.
π 27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.
π 28. No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants.
π 29. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey.
π 30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh .
π 31. Person wey dey chop egg make e know say yansh dey pain fowl.
π 32. Thousand trousers no dey stop dysentry.
π€£π€£π€£π€£π€£π€£π€£
Source: DJ Baddo Originator
Leave a Reply